Sports

Valverde Land Hospital After E Clash With Tchouaméni

todayMay 7, 2026 4

Background
share close

Serious gbege don burst for Real Madrid camp as midfielder, Federico Valverde land hospital after hot clash with teammate Aurélien Tchouaméni after training.

Reports talk say Valverde go hospital near di club training ground after e suffer face cut wey doctors hellep am stitch.

Di wahala start from Wednesday training after both players exchange hot words, but di matter no cool as e still continue on Thursday.

Reports still talk say Valverde no gree shake Tchouaméni hand, later tackle am hard for training, before both of dem enter full dressing room showdown wey leave Valverde with injury.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds