obodo oyinbo

Mexico Wan Close School Sake of World Cup and Hot Weather

todayMay 9, 2026 6

Background
share close

Mexico government don yarn say dem go close schools 40 days before normal time because World Cup dey come and hot weather don too much for many parts of di country.

Education oga Mario Delgado na im yarn dis one on Friday for one event wey happen for Sonora, Northern Mexico, say dem go close school on June 5 make pikin and teachers no suffer for di serious heat, and so gorment fit focus on preparations for World Cup matches wey go happen for di country.

Di announcement vex plenty pipo, as many dey question why football matter go join body for decision wey concern children education.

But Delgado sti talk say gorment dey reason whether to shift di next school resumption date come closer than di original August 31, so students no go lose too much school time.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds