By: Esther Ayoola
US Presido, Donald Trump, don comot body for Iran peace deal, say dia terms nor make sense at all.
Like dis, trump rejection, don dey increase fear say, gbege fit start again for Tehran.
Earlier on Sunday, Iran reply US last peace proposal, but warn say dem fit retaliate if US carry out any new attack.
Iran also tuk say dem no go allow more foreign warship enter Strait of Hormuz.