By: Esther Ayoola
French Presido, Emmanuel Macron don declare say di plan to return African artworks wey dem bin thief during colonial time don become something wey nobody fit stop again.
Macron yarn dis one for economic summit for Nairobi, and e remind people say e don promise since 2017 to help return di stolen works back to Africa.
According to reports, France parliament just pass law wey go make am easier for dem to return plenty cultural artefacts wey dem carry comot Africa many years ago.
Even though some pipo dey against di move, Macron insist say restitution no be about shame, and Macron say based on plans on ground no body fit stop di returning.