OBODO NAIJA

INEC to Use 1.4 Million NYSC Members for 2027 Elections

todayMay 12, 2026 1

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Di Independent National Electoral Commission don announce say dem go deploy more than 1.4 million National Youth Service Corps members for the 2027 general elections across di obodo Nigeria.

INEC Chairmo, Prof. Joash Amupitan, naim make dis announcement on Monday during one courtesy visit to NYSC headquarters for Abuja, wia e meet di NYSC Director-General, Brig.-Gen. Olakunle Nafiu.

According to statement wey di Chief Press Secretary to the INEC Chairmo, Adedayo Oketola release, di meeting na to ensure say INEC and NYSC work as ejima in  future elections.

Amupitan explain dat  NYSC members,  nor dey useless oh,  and dat dem get role to play for democracy.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds