By : Jolayemi Olajide
Lagos State Police Command don assure say dem go join body with Independent National Electoral Commission (INEC) ahead of di 2027 general election, to make sure say gbege no burst for Lagos at all at all.
For statement wey police tuk tuk pesin, SP Abimbola Adebisi drop on Wednesday, after INEC officials pay courtesy visit for police headquarters for Ikeja.
Lagos State Resident Electoral Commissioner, Abayomi Salami wey lead di visit, hail CP Tijani Fatai for im new appointment, come press say make Lagos State Police Command no relent, as preparation for di 2027 general election don start.