By: Esther Ayoola
Say confusion gadima for Oyo State, as Pipos Democratic Party (PDP) , di branch of Oyo State Govo, Seyi Makinde, drop update say dem wan screen 3,181 pipo wey wan run for different position for di 2027 general elections.
Di Oyo state govo put dis one for Inside statement wey dem release for X on Sunday.
Say, out of all di pipo wey register, 2,122 dey go for House of Assembly, 748 for House of Representatives, 198 for Senate, 112 for governorship, and na only one person wan run for president.
Di party say everything dey hapun online according to dia timetable, and di nationwide screening go start across di country on Tuesday.