By : Jolayemi Olajide
JAMB senior oga, Fabian Benjamin don announce on Thursday say dem don release 279 UTME results wey dem bin sieze afta clear investigation show no evidence of exam malpractice.
Di board explain say dem clear dis results following deep checks across Nigeria, while dem cancel other results wia proof of cheating dey.
Dis action come as part of di board effort to maintain exam integrity after dem earlier hold back di results for investigation.