Sport Yarns

Rangers Flog Ikorodu City 2-1 to Carry NPFL Cup for 9th Time

todayMay 25, 2026 3

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Everywhere stew for Enugu State on Sunday as dem collobi di Nigeria Premier Football League (NPFL) trophy for the ninth time, beatingĀ  Ikorodu City 2-1 for inside Lagos , but bad market hit Remo Stars wey go relegation because dem fail to beat Bendel Insurance.

The Flying Antelopes enter the pitch with heavy pressure because dem know say. na only win go give dem the cup.

Even with the tension, Chidiebere Nwobodo show say im na senior player as he score two correct goals for the 30th and 52nd minutes to put Rangers for front.

Ikorodu City player, Moses Ali, later pull one goal back for the 58th minute, but Rangers hold diaĀ  ground tight till the blow the final whistle.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds