By : Jolayemi Olajide
Naija and Türkiye don sign fresh agreement for Istanbul to join hand work for solid minerals and mining mata.
Nigeria Minister of Solid Minerals Development, Dele Alake, naim use im yamchop mouth break di news say Baba Tinubu support di movement.
Alake say di country don ready to work with the Turkish gornment to change how they dey manage mining, train pipo, and bring beta development.
He con add say di new changes inside Naija mining sector for the past three years don make di business sweet well-well for original investors.