south west

Army Send Special Forces To Rascal Bad Boys

todayMay 27, 2026 6

Background
share close

Di Chief of Defence Staff, General Olufemi Oluyede, don order make dem deploy special forces and plane elements to Oyo State sake of di recent kidnapping wahala.

Di Director of Defence Media Operations, Maj. Gen. Michael Onoja, tuk dis one for Abuja on Tuesday as he give update on top di work wetin army do for May.

Onoja sti assure residents say soldiers nor go rest at all until dem catch all di kidnappers and bring total peace back to di region.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds