Sport Yarns

Femi Azeez Score Two Goals As Super Eagles Flog Zimbabwe To Enter Unity Cup Final

todayMay 27, 2026 5

Background
share close

Millwall forward Femi Azeez shine wetin nor good yesterday for im first match for Naija, as im kpake two goals take help Super Eagles flog Zimbabwe.

Di boy sharp like razor blade, im sha  put behind am di pain say im club miss out for Championship play-offs, score first goal inside di first five minutes of di game.

Azeez sti come add another goal afta one hour pass, to make sure say Naija senior men get beta win.

Dis win mean say Naija never lose any game for Unity Cup history, and dem ready to defend dia cup for di final on Saturday against either Jamaica or India for Charlton Athletic stadium.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds