By: Esther Ayoola
Fire wey catch girls dormitory for Utumishi Girls Academy for Nakuru County, Kenya, don kill at least 16 people while 73 others dey hospital.
Police source wey tuk to AFP say di fire start around 1 o’clock early Thursday morning as more than 220 girls bin dey sleep for di hostel.
Emergency workers, ambulance people and rescue teams quickly reach di school to help victims and carry injured students go hospital.
Kenyan Red Cross tok say rescue operation sti dey go on, while authorities never know wetin cause di fire and never confirm if all di victims na children.