obodo oyinbo

13 Kpai For China Highway Crash

todayMay 28, 2026 5

Background
share close

By: Esther Ayoola

At least 13 people don die and 3 others injure after minibus jam truck for highway accident wey happen for Henan province, central China, early Thursday morning.

China traffic police tok say di crash happen for G40 expressway near Nanyang city, as di bus carry 16 people instead of 9 wey am suppose carry.

According to di police, di bus jam truck for di major road wey dey link Shanghai go Shaanxi, but dem never confirm di exact reason for di accident yet.

Authorities say investigation still dey go on as emergency responders rush carry injured people go hospital after di crash.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds