By: Esther Ayoola
Naija U17 women national team, di Flamingos, don qualify for di third and final round of di 2026 FIFA U-17 Women’s World Cup qualifiers afta dem beat Guinea wetin nor good.
Following dia initial 5-0 win for Abidjan, di girls change am for di second leg inside Ikenne on Sunday as dem wire Guinea 6-0 to finish di match 11-0 on aggregate.
Oluwakemi Adegbuyi na him first score for di 9th minute before di team Captain, Harmony Chidi, use one heavy long-range beta strike double di lead.