By: Esther Ayoola
Bauchi State Govo, Bala Mohammed don clear air say e no get anything to do with aproko wey dey fly. dat im and former Presido, Goodluck Jonathan naim wan package PDP, 2027 presidential ticket.
Di govo react afta social media gist begin spread say Jonathan naim be presidential candidate of one faction of PDP wey Kabiru Turaki dey do oga, madam for.
And dis one hapun for one special national convention wey happen for Abuja on Saturday.
Even though Jonathan no attend diconvention, Bayelsa lawmaker Fred Agbedi collect di certificate of return for jojo, a move wey don scatta di political space.