By: Esther Ayoola
Oyo State Police Command on Monday for Ibadan arrest two suspects, one pastor and one woman, over acuusate say dem deliberately spread false information say bandits kill six people for Lamini Community, Ido Local Government Area.
Police tuk, tuk, DSP Olayinka Ayanlade, naim dey convasate dis mata say di arrest hapun afta thorough investigation wey confirm say di viral WhatsApp voice note and social media post no true.
Im con sti explain say di fake report about armed attack and killing of residents cause fear, panic and tension among people for di community and nearby areas.
Police add say dem carry out di arrest to stop misinformation and warn public make dem always verify news before dem share am.