By: Esther Ayoola
Ireland Immigration Service Delivery don announce say all international students wey no be citizens of European Economic Area and wan study for Ireland pass three months gat get long-term study visa before dem travel enter di country.
According to report wey Economic Times carry on Tuesday, di immigration authority tuk say applicants must apply from dia home country or any country wey dem dey legally reside before dem fit travel.
Dem explain say students fit start the application process up to three months before dia travel date by filling online form through Ireland Automated Visa Application and Tracking System.
Afta completing di form, applicants go print, sign and date dia application summary, pay di required visa fee if e apply, and submit all supporting documents so dem fit process dia study visa.