By: Esther Ayoola
Di Joint Task Force troops for North-East do small jacki chan gbab some terrorists and rescue some pipo under di operation wey dem call ‘Operation Desert Sanity V’.
Media Information Officer for Operation Hadin Kai, Lieutenant Colonel Sani Uba, naim clear face on Thursday dey explain how dem carry high spirit enter di terrorists.
Among di pipo wey get freedom na one 20-year-old woman, Maryam Muhammad, and her one-year-old baby boy, Bello, wey di terrorists carry go since March 3, 2026, during attack for Ngoshe community.
Army people don carry di mother and her pikin go do check-up for hospital before dem hand dem over safely to dia family and Ngoshe community leaders.