By: Esther Ayoola
Di Minister of Works, Senator David Umahi, don warn contractors on Saturday, say im go clear out anyone, whether na Nigerian or foreigner, wey go try am delay gornment project.
Umahi tuk dis one during inspection of de Mararaba-Keffi and Zuba-Kaduna road work.
Im press tuk say any company wey no fit invest dia own money to move work forward while dem dey wait for federal gornment payment, no really get di progress of Nigeria for heart.