By: Esther Ayoola
Secretary to Gornment of Federation (SGF), George Akume, don go cast wi former Vice Presido, Atiku Abubakar, say im na one of di leaders wey support, make dem dey rotate presidency for Naija like barbar chair afta dem cancel June 12, 1993 election.
Akume yarn dis one for World Press Conference for Abuja as part of Democracy Day celebration.
Im say di annulment of di election wey late MKO Abiola win make political leaders take hard decision to protect unity and democracy for country.
Akume also expose how PDP leaders meet for Kaduna under Solomon Lar and Adamu Ciroma to discuss how power go rotate for Naija politics.