By : Jolayemi Olajide
Northern elders under NEF banner don cut chain dey drag we oga Presido, Bola Tinubu body say make im declare national security emergency before everyia scarra.
Di group tuk, tuk, Abubakar Jiddere, naim drop one hot statement about security mata for inside country, say e red.
According to Abubakar everybody dey shake because wetin dis jaguda boys dey do.
NEF make am clear say no country fit boast of any beta progress when communities dey under badness and citizens dey live inside heavy fear.