By : Jolayemi Olajide
Oga Director for City Boy Movement inside Oyo State, Olufemi Onireti, don distribute ogbonge medical equipment and drugs give Esinele community for Oriire Local Government Area on Tuesday.
Onireti wire dis beta donation during one solidarity visit to help di pipo afta bad boys go kidnap some teachers and school pupils inside di area.
Di politician speak inside the community say e get hope say dem go free di teachers and children very soon and dat di gorment dey work.
E tell di villagers make dem stay strong and pray as security agents and major stakeholders dey double dia efforts to clear di security mata.