obodo oyinbo

US And Iran Finally Drink Water Keep Cup

todayJune 19, 2026 6

Background
share close

After months of heavy fight, di United States and di Islamic Republic of Iran don finally sign one peace deal on June 17, 2026, for G7 dinner for Versailles, di deal talk say make everybody stop di war sharp sharp, and e give them 60 days to sit down for Geneva, Switzerland, to design permanent peace agreement.

Dis deal, wey dem dey call Memorandum of Understanding carry 14 points inside belle, as di deal wan stop any gragra first, them from there di two countries go build trust.

But we go sama you five points wey dey crucial to dis peace plan.

 

1. No More Fight & Respect for Country Boundary

Di deal order say make everybody stop all military operations “on all fronts” sharp-sharp. And dis ceasefire join Lebanon inside ooo, meaning say di U.S., Iran, and all dia guy-men must drop weapon. Di  two countries come still promise diaself say them go respect each other border and territory, and nobody go chook eye enter another person domestic mata.

 

2. Opening of Strait of Hormuz & Free Movement for Ship

To make sure say world economy stand gidigba as e use to dey be, di deal go systematically open di Strait of Hormuz.

For Iran Side: Tehran gree say make them open di Strait of Hormuz immediately for commercial ships, and nobody go pay any toll fee or give conditions for di next 60 days. Iran must also clear any “technical and military blockages”, which mean say make them comot all di bomb wey dey inside dia water.

For U.S. Side: Di United States gree say dem go scatter di naval blockade wey dey block Iranian ports with, and dem go reduce dia army for there within 30 days. Plus, U.S. promise say dem go pull out all their massive carrier strike groups from Iran area once di final peace treaty set.

 

3. $300 Billion Reconstruction Fund & Sanctions Relief

Dis one na di biggest bone inside di whole agreement, as di U.S. don gree say they go follow other countries pack $300 billion reconstruction and economic development fund to take build post-war Iran back. Aside that one, even though total clean-up of sanctions dey wait for di final treaty, di U.S. Treasury must comot hand immediately make Iran fit start to export crude oil, petroleum products, and other oil chemical derivatives so that Tehran fit get urgent cash flow.

 

4. Release of Frozen Cash

Di agreement talk say make them release over $100 billion of Iranian money wey dey for inside monkey cage for foreign bank accounts, say $12 billion go first drop, through banks for Qatar and UAE, and Iranian oga dem don talk say they go use dis first batch take pay all their government workers salary wey hang.

 

5. Nuclear Levels & “Down-Blending”

Di big agreement on top how Iran go dey enrich uranium (U.S. dey talk 20 years freeze, Iran say na 10 years them want) na di main work for di 60 days talk wey dey come. But for now, di temporary rule be say:

  • Iran firmly promise again say they no go find or build nuclear weapon.
  • To make sure say wahala no start again while talk dey go on, di two sides gree say Iran go start to “down-blend” (reduce di power of) their highly enriched uranium (HEU) stockpiles under di nose of the International Atomic Energy Agency (IAEA).
  • In return, di U.S. no get right to bring any new economic sanction or add more soldiers to di Middle East while this negotiation window dey open.

 

Even though world markets and brokers dey happy and celebrate dis deal as a massive win for world peace, some defense security people for both sides still dey look di matter with bad eye, because pipo dey tuk say di deal no fry mouth put on top Iran ballistic missile program and how they dey spend money on top proxy rebel groups but for di other side, hardline members for Iran parliament don blast di deal, say to leave control of Strait of Hormuz and accept U.S.-approved reconstruction money mean say dem don sell Iran independence.

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds