obodo oyinbo

Badenoch Drag Starmer, Call Am “Terrible PM”

todayJune 23, 2026 4

Background
share close

By: Yusuf Abuh

 

Kemi Badenoch don describe Keir Starmer as “terrible Prime Minister” afta e announce im resignation as Labour leader and UK Prime Minister.

Starmer talk say e go step down from Labour leadership afta less dan two years, but e go still remain Prime Minister until dem choose new leader.

Badenoch react for X say di Labour gornment fail wetin no good, for policies, including tax increase, welfare reform issues and underfunding of defence.

She also accuse dem of wrong economic decisions, dat di way dem take handle dia oil and gas business nor make sense at all.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds