By: Yusuf Abuh
Nor be small thing oh, say like Sri Lanka don deploy im military to fight mosquitos, say di mosquito dey misbehave dey spread on deadly fever wey dem dey call, Dengue fever, say na 1,000 don get dis sickness.
Di office of Presido Anura Kumara, explain, (dat if dem leave di mosquito, di mosquito go show dem sege) say army dem don send now, but e get di way dis mosquito go stubborn reach, dem go send navy and air force to destroy di mosquito breeding carbarns, since di mosquito nor gree respect demselfs.
Dengue fever na serious sickness wey fit cause high fever, headache, vomiting and body pain, and for worse cases e fit lead to death, naim dis mosquito dey carry.