Nor be small tin for South Africa, as police block everywia say xenophobic groups wan drive foreigners to comot.
Dem lock up shops tight and streets quiet like say na grave yard for Johannesburg as police dey patrol to block any kind fight or looting.
For Durban, small groups of protesters wey wear Zulu clothes and hold stick and shield gather for park dey sing “abahambe”, wey mean “make dem go”, while security people dey watch dem closely.
Nor be hear for south Africa.