obodo oyinbo

Gaza Mark 1,000 Days Of War Wahala As Over 73,000 Pipo Kpai

todayJuly 2, 2026 6

Background
share close

Gaza officials don announce say di war don clock 1,000 days, as over 90 percent of di territory don suffer serious damage from di fighting.

Di Gaza Gornment Media Office talk on Thursday say Israeli forces now control about 80 percent of Gaza land.

According to di latest figures from Gaza, at least 73,066 Palestinians don die since di war begin for October 2023.

As di war continue, international organizations dey raise fresh alarm over di collapse of hospitals, roads, schools and other basic facilities, while thousands of pipo still dey battle hunger, displacement and daily suffering.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds