By: Yusuf Abuh
One house of Rep member from Benue, Philip Agbese don beg wi oga Presido, Bola Tinubu, make im match break for di proposed NYSC reform until beta eyes look di mata wella.
Di lawmaker wey be number 2 tuk-tuk person, yan dis one on Sunday, say even though dem need to modernise di scheme, e no suppose spoil di main aim wey be to unite Nigerians.
U sabi say Di Minister of Youth Development, Ayodele Olawande, bin arrange NYSC orientation camp for three phases and introduce 11 career paths for corps members to choose from.
Agbese insist say gornment suppose hear more stakeholders, dat is di pipo wey dey involve, before dem suppose do any rearrangement.