By: Yusuf Abuh
Ekiti State Police Command do small kpichao arrest four suspect, say dem bin wan go move tins from shops inside Omisanjana area of Ado Ekiti.
Police tok say dem raid one criminal hideout on Sunday and gbab one, Abdurazak Suleiman, John Okori, Francis Okori and Kehinde Alabi.
As police look di holes dem, dem see plenty items, property wey di guys dem thief, including perfumes, bathing soaps, drinks, foodstuff, clothes, school bag and one 3kg gas cylinder, I be like say na hungry thief dem be.
Police still recover one sledgehammer wey di gang dey use take break into shops, while investigation still dey continue.