Edited by Ebi Oboko
Oyo State Govo, Seyi Makinde, don complain say pipo dey always blame state gofrnors anytime insecurity hapun, even though constitution nor give dem power to control security agencies.
Makinde tok dis one on Friday after closed-door meeting with Bauchi State Govo, Bala Mohammed, and APM National Chairman, Yusuf Dantalle.
According to am, dem discuss security, governance and political matters ahead of di 2027 general elections.
E insist say governors dey carry di blame for insecurity, but dem no get full authority to direct security operatives for dia states.