By : Jolayemi Olajide
Nigeria Police Force special team, on Tuesday, don go arrest Adeniyi Adeyemi for one place inside Osun State after Federal High Court for Abuja tell olukpa to arrest am.
Adeyemi wey dey call himself Director-General of Presidential Foreign Investment Promotion Council dey face eight-count charge wey include alleged conspiracy, forgery and impersonation.
Justice Mohammed Umar order make police arrest am after gornment lawyer, Wisdom Madaki, tell the court say the defendant no appear when dem call the case.
Adeyemi lawyer, Genesis Francis, however, tell the court say im client dey fear for im life an don beg oga Presido, Bola ttinubu to look di mata wella.