Lagos State Gornment don gbab 12 pipo wey dey dump dirty anyhow for inside Lagos Island, Yaba and Ikorodu.
Na LAWMA officials and KAI Corps carry out dis operation as part of gornment plan to wipe out dirty environment and force residents to obey waste management law.
LAWMA oga, Dr. Muyiwa Gbadegesin, talk say Project WISE Enforcement Team catch 11 suspects red-handed during surveillance for Lagos Island and YABATECH area as dem dey throway dorti anyhow.
Gbadegesin talk say all di suspects don dey custody, and dem go soon face court according to Lagos State environmental laws.