By Esther Daniel
Afrobeats star Davido don call im wife, Chioma Adeleke, im “life coordinator,” saying she dey help am manage im finances.
For one video wey don go viral, Davido call Chioma after e no fit log into im bank account to send money to im personal assistant, Lati.
Di singer ask Chioma make she transfer $4,000 to Lati on im behalf before dem travel back to Nigeria.
Di video don spark plenty reactions online, with many fans praising the love and trust between the couple.