OBODO NAIJA

Police Wire Call To Nigerians Say Make Everybody Surrender Dia Illegal Tools 

todayJuly 17, 2026 4

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Inspector-General of Police, Olatunji Disu, don announce say Nigeria Police don begin nationwide operation to recover illegal guns ahead of di 2027 general elections.

Disu yarn dis one on Thursday for Force Headquarters, Abuja, when e receive delegation from di National Centre for di Control of Small Arms and Light Weapons, wey retired Deputy Inspector-General of Police Johnson Kokumo lead come im office  .

According to di IGP, di operation go become more serious as election dey draw near because plenty criminals still dey use illegal weapons to cause insecurity across di country.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds