By: Yusuf Abuh
Kogi State Commissioner for Information and Communications, Kingsley Fanwo, don announce on Thursday say security operatives rescue four students, dia principal and one NECO and hoc staff wey kidnappers carry from one school for Odo-Ekina, Dekina Local Government Area.
Di victims bin dey abduct on Tuesday after gunmen attack di school during examination activities.
Fanwo tok say Govo Usman Ododo immediately order coordinated security operation, and heavy pressure from armed security personnel force di kidnappers abandon di victims for forest before dem run away.
E add say security operatives still dey comb di forest to arrest di criminals and make sure say dem face justice.