By: Yusuf Abuh
Six candidates go face public debate on Thursday as dem dey fight to become di next United Nations Secretary-General after Antonio Guterres.
Di debate go happen for UN General Assembly Hall, where diplomats, UN workers and civil society groups go ask di candidates questions before di selection process start next week.
General Assembly President Annalena Baerbock say di debate go help people know wetin each candidate plan to do if dem become UN boss.
Di next UN leader go face big work because di organisation dey battle money problems and criticism over how e dey run im affairs.