American rapper Cardi B don tok say if any of her sons giv girl belle, na di same day na im go tell am make e comot for house.
For one video wey she share, Cardi B tok say anybody wey make adult decision suppose ready to carry adult responsibility.
She add say her son go need find work, stand on im own financially and take responsibility for wetin e do instead of depending on im parents.
Video:https://www.instagram.com/reel/DbLdOBQoVGB/?utm_source=ig_web_copy_link&igsh=MzRlODBiNWFlZA==