Sports

Flying Eagles Crash Out from AFCON

todayAugust 10, 2026

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Nigeria Flying Eagles like deve collectors, don go collect 4-1 defeat from Burkina Faso Young Stallions for di final of di 2026 WAFU Zone B U-20 Championship for Ivory Coast on Sunday.

Di loss mean say Nigeria no go qualify for di 2027 Africa U-20 Cup of Nations and di 2027 FIFA U-20 World Cup for Azerbaijan.

Burkina Faso, wey don already beat Nigeria 2-0 for group stage, complete di double as dem join Ghana to represent WAFU Zone B for next year’s U-20 AFCON.

Nigeria hopes of revenge die early as Burkina Faso score three goals inside di first 15 minutes before dem finish di match 4-1.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds