Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
todayAugust 15, 2026 26 3 3
Marriage no be just about two pipo wey dey live under one roof. E dey involve trust, communication, friendship, sacrifice, patience and di ability to respect and protect each other, even when things hard.
But wetin go happen when di trust disappear?
Wetin go happen when suspicion replace communication, quarrel replace affection, and di pipo wey promise to protect each other begin to hurt each other?
Read dis story very well as e go giv us one painful answer:
Once upon a time, one couple love each other deeply. Di husband dey proudly tell pipo say e wife na di best thing wey ever happen to am. Their house dey full of happiness, and their children grow up believing say their parents’ love go last forever.
But then, distance enter di marriage. Di husband begin dey spend more time away from house because of work, but he no explain giv him wife, so from there small small, suspicion enter. Di wife begin dey suspect am, believe say e dey see another woman, even though she no get any evidence.
Instead make di man explain giv him wife, he no explain, dey reply her with hard voice, na so she dey begin to overthink am.
Di two both of dem no make move to solve di matter through honest communication, na so di marriage turn battlefield of accusations.
And na here many marriages dey begin break. E no always mean say one pesin dey cheat, and e always mean say pesin dey spy on you.
Sometimes, marriage dey collapse because couples stop to dey follow each other talk, instead dem go dey hear wetin pipo for outside dey talk about their partner.
Friend go talk something, relative go add another story, somebody go whisper something.
Before you know am, suspicion don become stronger than trust.
As thing come worse, di husband try explain things giv him wife say everything na lie, but she don already allow di suspicion change di way she dey see her husband., and dis one come lead to everyday fight.
As dem dey fight, dia children begin dey notice small small, so tay dem know when to stay inside their room, dem know when not to ask questions, dem know when their parents dey vex.
Wetin be all dis kind thing naaaaa? na so one of their pikin talk, start to dey question whether marriage dey right for inside him mind.
Di children no just dey watch their parents’ marriage, dem dey learn from am.
But di parents no know say their marriage dey teach their children something.
When children see their parents communicate with respect, dem learn say disagreement fit get solution. When dem see forgiveness, dem learn say mistake no have to destroy relationship.
When dem see affection, dem learn wetin emotional safety mean. But when dem constantly see shouting, insults, threats, suspicion and manipulation, dem fit begin believe say na so love suppose be.
And many marriages dey like dis for inside wi Obodo Naija, and dis one no good because broken homes fit break di next generation, so make husband and wife know say their marriage fit make or break di future generation.
Written by: Rilwan Agbomeji
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Â
Copyright KONFAM 2026
This will close in 0 seconds