By: Mariam Ajayi
Ogun APC don konfam Senator Solomon Adeola, wey dem dey call Yayi, as di party candidate for di 2027 governorship election.
Party chairman, Yemi Sanusi, talk dis on Sunday for Ogun, say Abayomi Hunye claim say he be di candidate na lie and make people nor mind am.
Former APC lawmaker, Kayode Oladele, also criticise Hunye for still dey fight for di ticket and recently unveil im running mate.
Oladele say APC don finish di nomination process and send Yayi name to INEC, so Hunye claim no get ground.