Lagos

Seven Kpai for Lagos-Ibadan Expressway Road Askident

todayAugust 24, 2026 4

Background
share close

By: Mariam Ajayi

Seven persons don kpai while two others sustain wunjury after three motor jam for Kara axis of Lagos-Ibadan Expressway on Monday.

Federal Road Safety Corps (FRSC), Ogun State Command, confirm say di crash happen around 12:03am and involve one truck, one trailer and a Mitsubishi Canter.

FRSC Ibafo Outpost receive di report around 12:04am and officers reach di scene about five minutes later.

All di pipo wey dey involve for di crash na men, Seven out of dem kpai, while two others sustain wunjuries.

Di FRSC official classify di askident as fatal multiple road crash, with speed violation identified as di likely cause, while touchlighting still dey continue.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds