By: Mariam Ajayi
One security man wey dem identify as Stanley don kpai after two suspected cult members shoot am for Royale Estate, Sangotedo area of Lagos, on Friday night.
Witness say di attackers storm di estate around 10pm to 11pm, shoot Stanley several times including for di head, before dem fire shots into di air and run comot.
Lagos State Police Command tok tok pesin, Abimbola Adebisi, confirm di incident on Monday, say two unknown persons riding motorcycle carry out di attack.
Adebisi say police don start to dey touch light di killing, but dem never gbab anybody yet.