By: Mariam Ajayi
Presido Tinubu don hail security operatives and local hunters wey rescue 21 kidnapped pipu, with 15 NYSC corpers, from kidnappers’ hideout for Kogi.
Di team enter di forest for Ofu LGA and rescue eight men and 13 women.
Di victims don dey hospital where dem dey receive treatment before dem go take them to dia family
Tinubu say gorment no go stop until dem crush kidnappers and restore peace.