By: Mariam Ajayi
Some area jaguda boys beat persin, him name na Basit, di man kpeme, say di man wan bin do hit and run.
Di victim, wey just bounce back to Naija from obodo oyinbo and get wedding to do in two weeks, bin yam one resident for Patey area before boys chase am catch.
Eye-witness, Afolabi Lawal, explain say di angry area boys use bottle and heavy stick knack Basit for head till e lose consciousness, come kpeme .
Na so dem run scatter di moment dem notice say e nor dey breathe again, as at di time wi package dis report, police never fry mouth put for di mata.