obodo oyinbo

Iran Threaten Say E Go Block Hormuz After US Sink 3 Oil Tankers

todaySeptember 7, 2026 4

Background
share close

By: Mariam Ajayi

Iran top security boss, Mohsen Rezaei, don threaten to block road near Strait of Hormuz like road safety, come dey command ships to pass Oman side.

Dis one  pass pepper body sef,  as Iran Parliament Speaker, Mohammad Bagher Ghalibaf, vex warn America,  say, dem dey load  shege  for oil business, after US military sink three of dia oil tankers.

While dis big men dey drag muscle, Israel sef dey do dia own for one side, say  dem rain bomb for Gaza kill five people, plus settlers,  one teenage girl,  for West Bank.

Even with ceasefire paper wey US sign, Israel still go do  Lebanon anyhow,  firing  heavy air strike kill seven people come wound twenty others like say war just start.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds