Lagos

Lagos Police Vex, Gbab 4 Suspects Wey Kpai Abroad Returnee

todaySeptember 8, 2026 5

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Lagos police command dey vex oh, like dis dem arrest four suspent base on Lagos island jungle justice.

Lagos Police Command don lock four suspects inside cell after jungle justice beating wey dem take kpai kpai one abroad-returnee, Basit Kolade.

Lagos Police tuk, tuk, Abimbola Adebisi, naim dey sorosoke di ogbonge update say dis wahala badness hapun along Freeman Street as Basit and e wife dey drive dia black Lexus Jeep, before one okada go hit dem from back.

Adebisi say na so dem begin drag, as dem dey drag na so di Basit enter motor reverse jam di okada again, na so boys rush am begin beat am until e kpeme.

And likes police sti dey investigate di mata.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds