Sports

Lamine Yamal React As Dembele Snub Am

todaySeptember 9, 2026 10

Background
share close

Barcelona winger Lamine Yamal don react after Ousmane Dembélé no include am among im top three players for Ballon d’Or.

Yamal jokingly ask whether Dembélé friendship with Kylian Mbappé fit get anything to do with di decision.

Yamal make di comment after football transfer expert Fabrizio Romano post am for X on Wednesday. With smile, Yamal talk say, “Na Kylian Mbappé padi e be, abi?”

But Yamal say e no get any bad blood with Dembélé, as e understand why di French player choose other footballers.

Yamal say, e really happy with the season wey I get. Anytime we play against each other, hin probably don do something wey make dem vex with me, and that one normal.

E add say, him and Ousmane dey very cool, and I understand say e wan choose other players.

Yamal say e still dey happy with wetin e achieve this season, adding say, he dey very happy with wetin I do this year, and he believe say everybody see am, even if Dembélé no see am.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds