By: Ayobami Dada
Falconets players Christiana Uzoma and Ramotalahi Kareem dey in good mood as dem prepare to face England Young Lionesses for di Round of 16.
Moses Aduku team go battle England for Bielsko-Biala Stadium on Thursday, today, as dem fight for place for di quarter-finals.
Falconets captain Uzoma say di team don fire up and ready for di important match.
Kareem play big role as Nigeria beat New Caledonia 10-1, wey help Falconets secure place for di Round of 16.
Di young player promise fans say Falconets no go disappoint dem for di tournament.