By: Kofoworola Olayinka
One speedboat don sink for Ibaka waterways, Mbo Local Gorment Area of Akwa Ibom State, on Thursday, September 18, 2026, as police rescue two pipu wey dey inside di boat.
Di blue W23 speedboat, wey dem mark LET’S PRAY, dey travel from Oron go Cameroon with goods around 1:30 p.m. on Thursday, when di boat run into trouble for water.
Akwa Ibom State Police tok-tok person, DSP Timfon John, say preliminary investigation show say di driver, wey dem identify as Mr Daniel, dey try adjust di boat seacock so e fit drain water wey don gather inside di vessel.
Police say di boat sink during di process, as dem rescue two pipu from di water while investigation dey continue to find out exactly wetin cause di incident.